Pastor Bolaji Idowu: Harvesters Church founder Bolaji Idowu deny billion naira real estate allegation

heraldtoday


Pastor Bolaji Idowu of Harvesters Church

Wia dis foto come from, Bolaji Idowu/X

Pastor Bolaji Idowu wey be di founder of Harvesters International Christian Centre don tok on di different allegations and concerns wey say e dey into real estate fraud.

Di Pastor say all di tori say im get properties for Nigeria na lie and anybody wey get evidence make e come out tok am.

Tori from some local media on Tuesday allege say police gbab Pastor Bolaji and dem dey kwesion am ontop real estate matter and money laudering.

Di viral tori claim say na for Force Criminal Investigation Department (FCID) for Abuja dem bin dey drill am ontop di matter.

Infact, di tori wey dey spread be say e go sleep for police net but interestingly, many pipo wake to see am for di early morning prayers wey e dey always do.

Pastor Bolaji na di convener of di popular Next Level Prayer wia thousands of pipo dey join to do early morning prayers.

On Wednesday di pastor appear for im channels wia im early morning prayers to address di allegations wey dey spread for social media and deny di tori say im buy or sell properties.

Pastor Bolaji Idowu react

Pastor Bolaji say im no get properties for Nigeria and no billions dey enta im account as some pipo don claim.

“E get plenti news about me for social media. I wan make some veri good fact clear, I hear say dem say I dey involved in real estate. Anybodi wey get evidence fit provide am, I no get any properties for Nigeria.”

Di Harvesters Pastor add say “di only properties wey I get for Nigeria na di one wey my late parents give to me.”

E clear say im no get any properties wey e buy or get for Nigeria, e maintain.

Ontop di allegations of real estate business, di Pastor say im no dey sell or buy properties.

“I no dey sell or buy properties. I no dey do dat kain business. Pesin tok say I dey receive billions into my accounts, my accounts dey public, you fit go check if I don eva receive billions.”

Pastor Bolaji go on tok tank pipo wey show concern wit addition say im go stiil address di mata.

Who be Pastor Bolaji Idowu?

Pastor Bolaji Idowu na di founder of Harvesters International Christian Centre wey don grow for different part of Lagos, Nigeria.

E create di church for 13th of December, 2003, wia e start wit small numbers of pipo but di church don grow wit different branches across Nigeria, di United Kingdom and di United States of America.

E also found di Next Leval Prayer wey be a faith-based morning prayer for believers.



Source link

Share This Article
Leave a comment