Wia dis foto come from, Getty Images
Police don arrest one pastor and church members for Rivers state, Southern Nigeria on top allegations say e dehumanise minors.
Dem also rescue small pikin dem wey dey endure beating for one Church for Eneka area of di State.
Dis arrest dey come afta one distressing online video spread online on Wednesday.
Di video show di pastor hold palm fronds, den use am dey flog di naked children.
Wit three oda adults for di video, di children be like dem dey sing or chant sometin as di pastor dey waka around dem.
E no clear wen di incident happun but police say na spiritual mata bin dey go on from dia investigation.
Di accused pastor and di church neva comment on di arrest of dia leader.
For statement by Police tok tok pesin, SP Grace Iringe-Koko say preliminary investigations reveal say di 41 year old Pastor allegedly organize three-day program for children for im church for “spiritual cleansing,” wey e claim say bin dey inspired by di Holy Spirit.
“Upon receiving dis information, operatives from di Rivers State Police Command through coordinated intelligence, arrest di pastor and several Church members for di scene.”
Di children bin kneel down naked while di pastor dey flog dem and even dey throw some of di smaller toddlers to anoda church members afta e flog dem for di “cleaning”.
Na neighbours for a nearby building wey video how di incident dey take place for several days raise alert of wetin dey happun inside di church compound.
Di police say a thorough investigation currently dey go on to reveal wetin really lead to dat incident.
Commissioner of Police, Rivers State, CP Olugbenga Adepoju say dem dey committed to ensure di safety and well-being of all citizens, particularly vulnerable populations such as small children.