Pastor Tobi Adegboyega, founder of di Salvation Proclaimers Anointed Church (SPAC Nation) don lose im appeal with di goment of United Kingdom to remain within di kontri territory as legal resident.
UK immigration tribunal dismiss di appeal by di Nigerian pastor, to continue im stay for UK to attend to family and oda activities.
Pastor Tobi bin don file application to remain for UK as a legal resident since 2019 on di basis of im relationship wit im “British partner” but e no meet di relationship requirement becos e “overstay” and dem dismiss di appeal despite im several attempts.
Judge Moore dismiss di case and request Pastor Tobi make im return to Nigeria to make new application for “entry clearance” from im home kontri, Nigeria to United Kingdom.
Di judge claim say dia tribunal findings reveal say Pastor Tobi enta UK for 2005 on a “visiting visa” bifor meeting im partner for 2015 and e go dey unfair to di system to grant am permanent residency.
“Weighing all of di foregoing in di balance we conclude say di decision to refuse leave to remain dey wholly proportionate. Di Appellant seek to rely on family and private life relationships, all of which e don establish while e dey in di UK unlawfully, and dem fit survive im return to Nigeria. Di interference go therefore dey limited, and lawful in all di circumstances,” di tribunal tok.
‘Not deported’
Reactions bin don dey follow di tribunal ruling as local media begin report say di UK wan deport Pastor Tobi.
But Dele Olawanle, legal representative to Pastor Tobi say reports on social media wey say im client dey face deportation for UK na false and e no go make any further statement on di issue of deportation.
“Deportation na for criminals. E no be…” di lawyer tok.
Olawanle tok say di court no find im client guilty of any “wrongdoings” as regard SPAC Nation illegalities.
“Tobi don live in di UK for at least 20 years without any criminal conviction. E don contribute significantly to di British community. E don face many challenges, but na winner. Many of im adversaries na from di African community. Sensationalism na act of idiocy. E no worth di paper you write am on,” e tok.
“I read some comments dis morning and wonder why pipo dey quick to make ignorant comments without facts. I wonder why pipo belled dey sweet dem to see pipo go down, including so-called pastors. Society get big problem, as we no fit handle pipo wey dey different and want dem to go down. We love pipo wey act sheepishly wit zombie traits.” E tok.
Controversies ova di operation of SPAC Nations for UK
For 2022, di UK court order di immediate shut down of SPAC Nation, ova controversies of allegations of corrupt practices by di church say dem fail to properly account for £1.87 million.
High Court for UK say dem shut down di church group popularly known as SPAC Nation on 9 June, sake of say dem fail to properly account for more dan £1.87 million in expenditure and operate wit lack of transparency.
But Pastor Adegboyega wey deny di allegations say no be church di UK goment get issue wit and add say even if dem close im church, im no fit fight di goment but e neva reach dat level.
“If goment tok sometin, I no go dey fight goment. I don work wit dem, I dey epp dem do many tins sef. Na company dem get katakata wit, no be church,” e tok.
“Even dem know say wia I don reach for here, you no fit shut down my church now, how? Dem no go do am becos we neva do anytin wey wrong.”
Di Insolvency Service for UK say clear concerns dey around how di church group manage dia affairs.
Dem also tok say SPAC Nation fail to properly account for income wey dem receive from donations and oda expenditure.
Dem also no fit provide accounting records to prove di £1.87m wey dem say dem spend, wey be requirements by law.
But Pastor Adegboyega bin tell BBC say di issue wey im get wit di Insolvency Service na sake of say im neva give dem every record of dia transaction.
E say im church group dey give account of dia transaction and dem go continue to dey give account.
“If pesin read dat report well, e tok say we neva give dem everytin dem want but we don give dem most tins.
“And we no fit dey perfect. Time go dey wey be say we no get ABC,” im tok.
E say dem go-go back to court to challenge di decision to shut down im church group.
Who be di SPAC Nation leader, Pastor Tobi Adeboyega?
Pastor Tobi Adegboyega na Nigerian wey popular for UK, e dey always face public scrutiny ova im “extravagant lifestyle” and association wit Nigeria celebrities.
E be di founder of di Salvation Proclaimers Anointed Church (SPAC Nation), wey bin dey operate for UK since 2008 bifor authorities shut am down for accuse of corrupt practices in 2022.
Pastor Tobi Adegboyega wey dem born for Nigeria in 1980 move to London in 2005 and e bin dey close to im cousin, actor John Boyega wen im arrive for UK.
On 20 May 2020, Adegboyega reportedly step down as Lead Pastor of SPAC Nation and hand ova di church to Samuel Akokhia, bifor UK court order di total shutdown of di church.