Ogbonge men of God for Nigeria, Ghana continue dia tradition of New Year prophecies and declarations

heraldtoday


Collage of some ogbonge men of God for Nigeria and Ghana

Wia dis foto come from, RCCG HQ/Winners International/Prophetic Hill Church/Reign House Chapel

Wetin we call dis foto, Collage of some ogbonge men of God for Nigeria and Ghana

One tin wey some Christians for Africa dey look forward to during ‘cross-over services’ wey dey happun for churches on di 31st of December every year na prophecies and declarations from dia men of God.

Prophecies, giving of directions and prayers na part of di cross-over service to di new year for many churches for Nigeria, Ghana and oda parts of Africa for many years now.

Even though authorities over di years don warn make dis declarations dey done with caution, e never stop dem.

2025 no different. Dis na some of wetin some ogbonge and popular men of God tok about 2025.

Pastor Enoch Adeboye

Pastor Enoch Adeboye wear all-white wit microphone for hand during di 2024 cross-over service.

Wia dis foto come from, RCCG HQ

Wetin we call dis foto, Pastor Enoch Adeboye during di Cross-Over service for 2024

General Overseer, Redeemed Christian Church of God, RCCG, Pastor Enoch Adeboye wey pipo sabi as Daddy G.O give prophecy about individuals, Nigeria, health and economy.

Di pastor release im prophecies during di cross over service for Redemption City wia e declare goodnews for 2025.

“I get good news for you;

I no know wetin e be wey go make your full full, but very soon, as we cross di border to di year 2025, di manifestation of answered prayers go show for your life.”

“E no dey waste time for God to perform a miracle.

Weeping may endure for a night, joy go come in di morning.”

Bishop David Oyedepo

Bishop David Oyedepo wear all-white during di Cross-Over service for 2024 for Canaanland

Wia dis foto come from, Winners Chapel international X

Wetin we call dis foto, Bishop David Oyedepo during di Cross-Over service for 2024 for Canaanland

During di crossover service for Canaanland for Ogun state, Bishop David Oyedepo of Living Faith Church declare prophetic blessings. Dis na afta im tell im congregation about faith.

“No prophet get di power to make wetin God tok to happun. Na di faith of di individual wey go determine weda e go happun or not.

During di prophectic blessings im declare say “You go waka in majesty all through 2025!

Every pit wey dem bin dig for you, di pipo wey dig am go fall inside it by demsefs!

“Every gang up against your destiny go disappear from dia place! From lack to abundance go be your portion henceforth! Joblessness don end for your life!

Pastor Daniel Olukoya

Pastor Daniel Olukoya wear all-white for di Cross-Over service for 2024 as e stand for pulpit wit microphone.

Wia dis foto come from, MFM International Headquarters

Wetin we call dis foto, Pastor Daniel Olukoya for di Cross-Over service for 2024

Dr Daniel Olukoya na di General Overseer of di popular Mountain of Fire and Miracle Ministries.

Olukoya during di church annual cross over service on Tuesday declare say “2025 my year of undeniable victory”.

E also declare say “Year 2025 na a year of divine interruption, restoration of opportunities, unlimited deliverance, and di rise of Joseph, Esther, and Daniel and God go raise up transformative leaders.

Oda highlights of di declaration na say 2025:

“Na year wey prayerlessness dey extremely dangerous and year wey prayers dey needed to tackle strange economic and political turbulence (katakata).”

E say na year wey “we need prayer to tackle all massive weather turbulence (kasala) like floods and all kinds of disasters. We need prayers to tackle strange new infirmities (sickness).”

Prophet Nigel Gaisie

Prophet Nigel Gaisie

Wia dis foto come from, Prophetic Hill Church

Oga Nigel Gaisie from Ghana wey tok say political party pipo and oda goment supporters bin attack am sake of some of im prophesies for di last year, tok say make di new goment no do dat kind tin.

Im tok say make “di police no pursue men of God wey don dey do dia work for di spiritual realm.”

Im prophesies and declaration for di year 2025 touch on several tins, from a new religion wey e say go take over Europe to weather/climate issues and political changes for some countries for Africa.

Rev Dr ISaac Owusu Bempah

Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of Glorious Word Power Ministries

Wia dis foto come from, Glorious Word Power Ministries

Wetin we call dis foto, Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of Glorious Word Power Ministries

Rev Dr ISaac Owusu Bempah na di founder of di Glorious Word Power Ministries.

E say, “dis tins wey God bin reveal to us, ordinary pesin neva fit understand; na spiritual tin, so make pipo take dis tins seriously.”

Rev Owusu Bempah prophesies and declarations for 2025 also touch on political events, health, di economy and war.

Prophet Eric Boahen Uche

Prophet Eric Boahen Uche of di Reign House Chapel

Wia dis foto come from, Reign House Chapel

For di watchnight service for di Reign House chapel, Prophet Eric Boahen Uche also say “men of God go continue to prophesy wey be dia job, so make di police also do dia own job, but make dem no interfere for dia work.”

Prophet Uche make some controversial prophesies about political and economic events for Nigeria and Ghana as well as some global events wey go lead to death.



Source link

Share This Article
Leave a comment