Wia dis foto come from, NDLEA
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don arrest di general overseer of The Turn of Mercy Church, Adefolusho Aanu Olasele wey pipo sabi as Abbas Ajakaiye.
Dem arrest di clergyman on alleged multiple shipments of drugs into Nigeria.
Di anti-narcotic agency say Oga Olasele dey dia wanted list and dem bin don dey try to arrest am for months bifor e run go abroad to avoid di arrest.
NDLEA tok-tok pesin, Femi Babafemi say di agency arrest Olasele for im church for Okun Ajah, Ogombo Road, Lekki, Lagos, afta church service on Sunday, August 3, 2025.
E tok say NDLEA officers wait for am outside make e finish di Sunday worship service bifor dem arrest am.
“Officers wait for am since morning to conclude di Sunday worship service in di evening bifor moving in di moment e step out of di church premises,” di statement tok.
Di general overseer of The Turn of Mercy Church, Adefolusho Aanu Olasele neva get chance to defend imsef, but NLDEA tok say e go get im chance for court.
NDLEA tok say di arrest na afta e don allegedly run to go hide twice, e run go Ghana to hide for June wen di agencies begin trail am afta di seizure of two shipments of Ghana Loud and cannabis wey dem link am.
“Di first seizure of 200kg of di psychoactive substance na for Okun Ajah beach dem make am on 4th June 2025 while dem recover anoda consignment of 700kg of di same substance from im delivery van on 6th July 2025,.” di statement tok.
NDLEA allege say Olasele don admit for im statement say im ferry di illicit consignments through di waterways from Ghana into Nigeria.
Di agency also claim say di clergy man confess say e run to go Ghana to hide afta e escape arrest twice in di past.
“Di arrest come afta e avoid arrest twice and run to Ghana to hide since June wen operatives start trailing am following di seizure of two shipments of Ghana Loud, one strain of cannabis wey dem link to am,” di statement tok.
“For im statement, e admit to ferrying di illicit consignments through di waterways from Ghana into Nigeria, adding say e don run go to di West African country to hide afta e escape arrest twice in di recent past.” Confessions wey BBC no fit confam.