Reverend Father for St Columbus Catholic church Amaimo shoot and kill boy wey dey fire banger on watch night day – Report

heraldtoday


Di church wia dem shoot di boy
Wetin we call dis foto, Police no mention di name of di fada wey shoot and kil di boy

Nigeria Police Force, Imo State Command say dem don begin torchlight di truth behind tori say one Catholic Reverend Fada wey dem no mention im name, shoot and kill one young boy on New Year Eve for Amaimo, Ikeduru local goment area for Imo State.

Inside one statement wey Imo police tok tok pesin, Henry Okoye give, e say di police go brief di public about di shocking news as dem learn more.

E never too clear wetin really happun and how e take happun.

But reports say, one fada for St Columbus Catholic Parish, Amaimo, bin shoot and kill di boy afta e continue to throw knock outs inside di church compound, even afta im warn am to stop.

According to one of di many tori wey BBC no fit to confam yet, di fada bin shoot gun for air afta di boy no gree stop, and na di bullet wey im bin shoot come down hit di boy.

Odas claim say di fada just pick im gun shoot di boy becos im throw knock out.

Di incident shock di villagers of Amaimo, plus make pipo for social media para no be small.

Wen BBC Igbo visit di area to hear wetin area pipo get to say about wetin happun, di pipo wey dem tok to explain say dem sef bin hear about wetin happun as dem bin dey prepare for dat night.

Amaimo town
Wetin we call dis foto, Amaimo town

Dem add say one more pesin injure for di incident and im dey hospital now for treatment.

Di victim papa, Oga Godwin, tell BBC say, “I bin dey house wen dem tell me say dem shoot my son. Na my wife go police station to report wetin happun.”

One woman wey bin speak wit BBC but no want make dem mention her name, explain give BBC Igbo say di boy wey die no be from dat community or from Imo State.

“Dat boy come from anoda state to come work for somebody for our town,” di woman tok.

Dem dey call for proper investigation to determine wetin cause dis tragedy.

Ikeduru local goment area na one of di hot spots for di troubled south eastern Imo state for Nigeria.

On June 11 2024, unknown gunmen shoot and kill two policemen plus one civilian for one checking point for Akabo, Ikeduru local goment. Afta dat, dem begin drive roughly as dem shoot gun anyhow for di area.

In recent years and months, Imo state don suffer several random, unprovoked attacks and kidnapping of civilians, catholic priests and security agents from unknown gunmen, and dis dey cause plenty tension for di minds of pipo of di state.



Source link

Share This Article
Leave a comment