Wia dis foto come from, Holy Trinity Catholic Church Maitama
At least 10 pipo, including children, die and several odas sustain injuries sake of stampede wey happun for di Holy Trinity Catholic Church for Maitama, Abuja, on Saturday morning.
Di incident happun as thousands of residents scramble to receive palliatives wey di church bin dey distribute.
Also for Anambra, three residents of Okija community lose dia lives sake of stampede, police tok-tok pesin for di state Tochukwu Ikenga tell BBC News Pidgin.
Di stampede happun on Saturday morning during one event for di distribution of rice for Amaranta Stadium, Okija, Ihiala local goment area of Anambra State.
Abuja stampede
Di Abuja stampede happun around 6:30 a.m. and claim di lives of ten pipo, including four children. Eight others sustained various degrees of injury.
Four of di injured don dey treated and discharged, while di remaining victims continue to receive medical care.
Di Federal Capital Territory (FCT) Police Command confam di incident and express sympathy wit di families of di deceased and wish swift recovery to di pipo wey injure.
”To prevent such unfortunate incidents for di future, di Command hereby direct say all organisations, religious bodies, groups, or individuals planning any public event, charitable activity, or large gathering for di FCT gatz notify di Police Command in advance.
“Dis go allow di deployment of adequate security measures to ensure public safety and prevent avoidable tragedies,” di Command tok-tok pesin Josephine Adeh tok for statement.
Adeh say if organisers no comply wit dis new directive, dem go dey liable for any incident or loss of life wey dia negligence cause.
“Di FCT Police Command remain committed to safeguard lives and property for di Territory,” Adeh add.
Anambra stampede
Anambra State Police Operatives say dem don take ova di scene of di stampede wey happun for Okija.
Di tok-tok pesin for di Anambra State Police Command Tochukwu Ikenga tell BBC News Pidgin say three pipo die as at di time of filing dis report, and add say police operatives dey currently visit di hospital for enquiries and details of di pipo wey injure.
“Preliminary information reveal say a known Philanthropist from di Okija Community, on im yearly schedule share some palliatives to di members of di community to provide succour to di less privileged.
“Unfortunately, bifor di event start, a large number of uncontrolled pesins take ova di event area wey bin result in stampede.
“Though di details of di affected pesins still dey sketchy, police operatives don take ova di scene for proper investigation,” e tok.
‘Di tragedy break our hearts’ Obi Jackson Foundation
Di Obijackson Foundation don express “deep sorrow” sake of di tragic incident
Di Foundation extend dia condolences to Govnor Charles Soludo, di bereaved families, and di entire Okija community.
“Dis tragedy break our hearts,” di Foundation tok..
“Di annual rice sharing event na labour of love, wey aim to bring joy and relief to dose in need.
“Say e result in such sorrow dey devastating beyond words,” di Foundation tok.
Di Foundation say dem go investigate di circumstances wey surround di tragedy thoroughly and to implement enhanced safety measures for future events.
Inspector General of Police order probe into incidents
Di Inspector General of Police (IGP) Kayode Egbetokun don order probe into di stampede at a food distribution event for Abuja and Anambra State.
For one press conference for Abuja on Saturday, police tok-tok pesin Muyiwa Adejobi quote di IGP.
Adejobi say di IGP tok say di say negligence on di part of dose wey dey distribute items dey criminal.
According to Adejobi, di IGP don mandate all police commissioners in di affected states to probe di incidents.
President Tinubu cancel im Lagos events in honour of Abuja and Anambra stampede victims
President Bola Tinubu don cancel all im official events for Lagos in honour of di pipo wey lose dia lives for Abuja and Anambra stampede.
Im special adviser on media and strategy Bayo Onanuga yarn dis one for statement on Saturday 21 December.
At least 10 pipo, including children, die and several odas sustain injuries sake of stampede wey happun for di Holy Trinity Catholic Church for Maitama, Abuja, on Saturday morning.
Di incident happun as thousands of residents scramble to receive palliatives wey di church bin dey distribute.
Also for Anambra, unconfirmed number of residents of Okija community lose dia lives sake of stampede.
Tori be say di incident happun for di gate of di Obijackson Centre, for Okija, Ihiala local goment area of Anambra State.
President Tinubu suppose watch di boat parade and oda activities of di Boat Regatta from di waterfront of im Oyinkan Abayomi Drive residence for Ikoyi.
“Dignitaries, including top officials of di Lagos State goment and white cap chiefs from di State, don already sit wen di President cancel im appearance following briefings on di tragedies,” Onanuga tok.
President Tinubu urge states and relevant authorities to enforce strict crowd control measures immediately.
”In a season of joy and celebration, we grieve wit fellow citizens wey dey mourn di painful losses of dia loved ones. Our prayers of divine comfort and healing dey wit dem,” President Tinubu tok.